
22 January 2024
Nigeria beat Guinea-Bissau 1-0 to reach di last 16 for di 2023 Africa Cup of Nations.
Di only goal for di match come wen Opa Sangate divert Moses Simon cross inside im own net seven minutes before di break.
Both sides bin score goals wey dem rule out as offside for second half, while Nigeria striker Victor Osimhen also get one effort wey dem cancel sake of handball.
Di result mean say Jose Peseiro side finish second for Group A behind Equatorial Guinea, wey beat hosts Ivory Coast 4-0.
Super Eagles go face di second-placed side from Group C, wey fit be Senegal, Guinea or Cameroon, for di last 16 on Saturday by 8pm West African Time.
Second half

90+6 mins- Referee don blow whistle to end di match
90+5 mins- Calvin Bassey don collect yellow card.
90+4 mins- Substitution! Chidozie Awaziem don enta Ola Aina don comot
90 mins- 5 mins of added time
88 mins- Poor free kick from Guinea Bissau, di player waya shot wey go hih outside di pitch
87 mins- Free kick to Guinea-Bissau
85 mins- Guinea- Bissau get corner, dem cross inside di area but di defence clear di ball
84 mins- Dis look like offside for di build-up play di referee don blow for offside
78 mins- Big chance for Nigeria,Ola Aina cross from di left to Victor Osimhen but im header miss di goal
77 mins- Play don start again, Nigeria hold ball
75 mins- Referee don blow for cooling break
72 mins - Offside again to Victor Osimhen
70 mins- Ola Aina miss big chance! Im fire di ball high ova di bar from inside di 6-yard box afta im collect ball inside di box.
68 mins- Substitution Ze Turbo don come in for Famana Quizera.
65 mins-Fine pass from di edge of the box but by Alex Iwobi shot on goal go wide
64 mins- Moses Simon corner kick dey cleared
62 mins-Substitution for Nigeria, Raphael Onyedika dey replace Frank Onyeka and Alex Iwobi replace Joe Aribo
58 mins- Victor Osimhen score from close range but referee blow say di Nigerian dey offiside
55 mins- Ola Aina cross find Victor Osimhen but im head di ball ova di bar
50 mins- Frank Onyeka don collect yellow card
47 mins- Big chance for Nigeria! Moses bin dey free inside di box but im shot no fit beat di goalkeeper
46 mins- Zinho Gano don enta for Franculino.
46 mins- Baciro Cande don make change during di break. Marciano Sanca don enta and Carlos Mendes don comot
46 mins- Match don start
Players don enta field
First Half
45+5 mins- Halftime don reach, referee don blow im whistle
45+4 mins- Big Chance! Victor Osimhen miss good opportunity to score im head di ball wide aft aim teammate cross fine ball to am
45+3 mins- Ola Aina don collect foul. Bouchra Karboubi di referee bin see wetin happun.
45 mins- 4 additional min na im dem go play.
44 mins- Semi Ajayi go need to dey very careful for di rest of the match aft aim collect yellow card from di referee for bad tackle.
43 mins- Famana Quizera collect ball and find himself for good position to strike from di edge of di box, but im attempt dey blocked.
41 mins- Cross inside di penalty area from Famana Quizera but e dey weak.
40 mins- Moses Simon tries to find di head of im teammate inside di box but im overhit di cross.
37 mins- 0 - 1
Na own goal! Bad moment for Opa Sangante, wey try to clear cross inside di six-yard box but instead im send di ball behind im own keeper. Di score is 0:1.
33 mins- Guinea Bissau play long pass forward but di striker no fit control di ball
32 mins- Di referee don blow for cooling break.
29 mins- Surely dis na handball by one of di Guinea Bissau players for di box, but di referee just wave play on!
23 mins - Famana Quizera cross poor from di corner kick. Di ball don go out of play.
22 mins- Di ball dey cleared afta Carlos Mendes bin attempt to dribble past an opposing player. Di linesman point to di corner flag, Guinea Bissau go take am.
21 mins - Dalcio shot from distance but fails di shot no disturb di goalkeeper.
21 mins-Joe Aribo collect pass and try im luck from mid-range towards di middle of di goal, but Jonas Mendes make easy save.
17 mins- Victor Osimhen dey offside linesman don raise im flag
15 mins- Samuel Chukwueze play one dangerous cross inside di box, but di defence clear di ball first man.
14 mins- Frank Onyeka run towards goal but di defender recover well to challenge am. Di ball don comot na corner kick to Nigeria
13 mins- Famana Quizera long-range shot don go high and wide. Di ball don comot for field na goal kickto Nigeria.
10 mins- Ola Aina play poor cross inside di box produced but di ball do go out of play.Na throw in to Guinea Bissau.
9 mins- Throw in to Guinea- Bissau
7 mins-Nito waya long-range shot afta one fine pass. Di ball go towards di middle of di goal, but edey easily stopped Nigeria goalie Stanley Nwabili
3 mins- Victor Osimhen dey offside di linesman don raise im flag.
3 mins- Moses Simon (Nigeria) collect di ball just outside di box, but im attempt dey blocked by one of di defending players.
2 mins- Victor Osimhen react well to get to collect di ball to takes shot from di edge of di box, but im fail to get di ball pass di players wey dey stand between him and di goal.
I min- Match don start

Guinea-Bissau line up
Guinea-Bissau XI: Mendes, Mendes, Ie, Sangante, Nanu, Bikel, Nito, Quizera, Dalcio, Gomes, Gano
Subs: Cande, Dju, Djalo, Semedo, Marciano, Djoco, Rodrigues, Encada, Cassama, Mane, Embadje, Ze Turbo
Nigeria line up
Nigeria XI: Nwabali, Aina, Omeruo, Ajayi, Bassey, Samuel, Onyeka, Chukwueze, Aribo, Simon, Osimhen
Subs: Moffi, Uzoho, Sanusi, Troost-Ekong, Musa, Onyemaechi, Iheanacho, Iwobi, Lookman, Onuachu, Awaziem, Nwadike
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomqSulWqFdsKWamqo